Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 22:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 22:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even if Yu sorry for wiked pipol, dem nor go still learn how to do wetin dey rite and even for where raitious pipol dey rule, wiked pipol still dey do wiked tins; dem nor dey si God glory wey dey kom.


Jerusalem, David town, una own don finish! Make una kontinue to dey do una sakrifice evry year, just as e suppose bi.


Naw, make yu listin, yu wey dey enjoy yorsef kon tink sey yu dey save and sikure. Yu tell yorsef sey, ‘I too mush and nobody bi like mi. My husband or shidren nor go ever die.’


Una own don finish! Una wey dey wake up for early morning bigin drink. Una dey drink still evening until di drink katch una well-well.


Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,


Una own don finish! Pipol wey bi champion for where dem for dey drink ogogoro! Dem dey get heart well-well wons e rish to mix difren drinks!


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.


“Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.


“Israel pipol, make una stop to celebrate una festival like doz wey nor know God. Una don turn from una God and nor dey faithful to am again. Una don sell unasef give juju like ashawo wey dey di land and una love wetin una tink sey love una.


If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die.


Yu dey live life wey yu dey enjoy and yu dey enjoy for dis eart. Yu don make yorsef fat, dey wait for di day wey dem go kill yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ