E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!
Jerusalem pipol, I go put pipol wey go dey guide una walls and dem nor go kwayet both for day and nite. But una wey dey pray give God, make una nor stop at-all.
God don forget en pipol like lion wey waka komot for en kage go find food. Dia kountry don turn desert, bikos dem dey fear pipol wey dey opress dem and dem dey fear God vexnashon too.”
Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”
“Like lion wey run kom from Jordan bush kon katch sheep for fine betta land, na so too I go make Edom pipol run komot from dia kountry. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos e nor get anybody wey bi like mi and nobody fit shalenge mi! Wish ruler fit go against wetin I tok?
Like lion wey kom out from bush near Jordan, na so too, mi wey bi God go kom attack and porshu Babilon pipol komot from dia town. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos nobody bi like mi and who go fit shalenge mi? Wish ruler fit follow mi make mout?