Yu send yor savant kom boast give mi sey yu don defeat di highest mountins for Lebanon with all yor shariot. Yu dey boast sey yu dey kut di cedars tree wey tall pass and di cypress tree wey fine pass for der. Yu still sey yu don rish di place wey far pass for di forest
“God still sey, ‘Una must obey all wetin I kommand. Una must nor karry load pass di town gates for Sabat Day. Una must si Sabat as holy day and una nor go do any work for dat day.