11 Dis message na about Edom pipol. Somebody koll mi from Edom land sey, “Yu wey dey guide, na wen day go break? Na wetin remain for di nite? Make yu tell mi wen all dis tins go end.”
My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”
Afta, King Zedekaya sey make dem koll mi kom, den e take mi go korna kon ask, “God give yu any message for us?” I ansa, “Yes! E give mi.” Den I sey, “Babilon king go kom katch and karry yu go.”