Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 20:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 20:6
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God go save pesin wey nor dey innocent, bikos yor hand dey klean.”


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.


Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”


God sey, “For dat time, all di tribe wey dey Israel, na mi go bi dia God and dem go bi my pipol.


Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.


Di time don rish wen dem go distroy Filistia pipol kon stop doz wey dey help Tyre and Sidon. Mi wey bi God go distroy Filistia pipol and all di pipol wey kom from Krete wotaside.


“Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell?


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


Wetin make us sey wi go dey free if wi nor listin to dis korrect salvashon message? Na God first tok am and pipol wey hear am kon show us sey na trut.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ