Si, yu really dey bilive sey Egypt pipol go kom help yu? Egypt wey bi like shuku-shuku; if pesin won rest put, e go wound di pesin hand. Dat na wetin King Fero for Egypt dey do to evribody wey dey trust am.
So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!
Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”
Dem kon tell Assyria sojas sey, Egypt sojas wey King Tirhakah for Sudan dey lead, dey kom attack dem. As di king hear dis tin, e kon send leta go give King Hezekaya
Israel pipol nor go ever go meet dem for help again. Bikos of wetin go happen to Egypt, Israel pipol go kon know sey, e nor even dey rite to go Egypt for help. Den Israel pipol go know sey na mi bi God wey get pawa.”