Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.
Una dey put perfume and oil for body go woship Molek wey una dey koll god. Bikos una dey find gods to woship, una dey send messenjas go far, even go rish where dead body dey.
But my God, Yu know all dia plan to kill mi. Nor forget di wiked tins wey dem dey do and nor forgive dia sin. Make dem die for yor front and make Yu ponish dem as Yu dey vex.”
Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.
E bi like sey dis tins get wisdom, bikos pipol dey woship angels; dey pritend sey dem good and dey sofa dia body, but dis wisdom nor get value, bikos e nor fit stop pesin make e nor do di yeye tins wey dey en mind.
Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.