Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 E go judge and setol kworel among nashons. E go setol many pipol kase. Dem go turn dia swod to ordinary blade kon use dia spear dey work for vineyard. Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem nor go train pipol to fight war again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 2:4
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E go ponish di nashons and dead body go full dia land. Yes! E go kut pipol head full di whole world.


God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”


E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.


So my God, make Yu raiz-up kon judge di world, bikos na Yu get all di nashons.


before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart. E go judge di world well-well and E go judge evribody akordin to wetin dem do.


and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.


God pipol nor go worry again; peace go dey dia house and dem go dey save.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


E nor go break di wood wey bend or lite lantan wey nor good. En good judgement go dey di whole world forever.


True-true, dem go burn di boot wey di sojas take fight and dia klot wey blood stain.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace.


I go keep my promise kon make yu my own, den yu go know sey na mi bi yor God.


Make una do una swod well kon sharpen una spears. Even pipol wey weak or nor get pawa, must fight.


Di pipol must ready kom Jehoshafat Valley. Na for der mi wey bi God go sidan judge all of dem.


God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.


God sey, “I go remove di shariot from Israel, den take di horse dem komot from Jerusalem and distroy evritin wey dem take dey fight war. Una king go make peace with oda nashons. E go rule from one sea to di oda: Even from Eufrates River go rish where di eart for end.”


bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”


Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.


God go skata en enemies; E go skata dem with tonda from heaven. God dey judge di world from biginnin go rish di end. E go give en king pawa kon honor di one wey E anoint.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ