Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 19:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 19:3
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”


Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.


Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.


For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”


Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am


So dem kon dey shake and stagga like pesin wey don drink and all wetin dem know, nor fit help dem.


God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do.


E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


True-true, God wey dey lead heaven sojas get plan and who go fit stop wetin E won do? En hand dey ready to ponish anybody. So who go fit stop am?


Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


Na mi dey fool pipol wey dey si vishon kon make dia work taya dem. I dey shange wise pipol advise to anoda tin kon turn dia wisdom to foolishness.


Naw, make yu dey use yor majik well-well; majik wey yu dey use since dem born yu. May bi e fit help yu or yu fit use am porshu trobol!


I give my pipol life and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.


But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”


Wetin make una mighty god wey dem dey koll Apis, fall? Na God strike am.


If dem ask yu sey wetin make yu dey kry, make yu tell dem sey, na bikos of di news wey dey kom. Wen di news kom, fear go katch dem well-well; dia hand nor go fit move, dia mind go fail dem and dia leg go dey shake. Di time don kom and na naw.” God wey get pawa don tok.


Wen I don finish with una, una tink sey una go get strent or pawa to karry una hand? Mi God don tok and I go do wetin I tok.


Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.


so di king kon sey make dem koll all di majishan; doz wey dey si vishon and di wise men, so dat dem go tell am wetin en dream mean. Wen dem kom, dem kon tell di king make e tell dem di dream.


Di king kon sey make dem go koll all di wise men, pipol wey dey si vishon and majishan kom. Den e tell dem, “If anybody fit read wetin dem rite for di wall kon tok wetin e mean, dem go wear am purpol royal garment kon gi-am gold shain wey get honor, den e go bi di nomba three pesin wey get pawa pass for dis kingdom.”


Wen day break wen Nabal eye neva klear well-well, en wife kon tell am wetin happen. Na wons e get stroke and e nor fit waka again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ