“Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple.
Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.
Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.
God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”
Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.