14 God don konfuse dem; dem dey give wrong advise and evritin wey Egypt pipol dey do, nor dey rite at-all and naw, di pipol dey stagga like drunkard man wey sleep on-top en vomit.
God sey, “I go make war happen for Egypt, dat time, broda go fight against broda and neighbour go fight against neighbour. Town go fight against town and kingdom go fight against kingdom.
Di world go stagga like drunkard man; e go shake like house wey heavy rain dey disturb. En sin go draw am fall for groun; e go fall and e nor go raiz-up again.
So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”
Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money, don turn to dia oga. My pipol, una leaders dey lead una anyhow and naw, una nor know di rite road wey una suppose follow.
Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem.
Jesus kon ansa, “Una wey nor get faith and wey nor know wetin to do! How long I go dey with una? How long I go bear with una? Make una bring di boy kom here.”