E get anybody wey bi like mi? Make e tok am! Make e kom out kon make mout for my front about wetin don happen since I kreate dis world and wetin go still happen! Yes, make e tok wetin go happen.
Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.
For dat time, one singol wise pesin nor go dey for Edom land again. Bikos on-top Edom mountin, na der I go for distroy all doz wey get sense.” Na so mi, God, tok.
Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?