5 And before dem go gada di grapes wey don ripe afta di new leaf don fall, I go use my knife take kut di branches wey nor dey produce fruit kon break all di bad branches.
Fig tree don dey bring fig fruit kom out and di breeze dey scent with fresh vines. So get up, make yu follow mi, my darlin and sweet wife; kom follow mi make wi dey go!”
But awa Oga God wey get pawa go kut and skata dem for groun like tree branches. Di ones wey dey proud and dey karry body up, God go ponish dem well-well.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.