Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 18:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 E go bad well-well for Ethiopia, di land where bird feada for dey make nois for river,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 18:1
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di king hear sey, King Tirhakah for Ethiopia dey mash kon fight am. E kon still send message go meet Hezekaya sey:


Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye. Make Yu hide mi under yor feada.


My God, si as I value yor love wey nor dey fail! Evribody dey save under yor feada shadow.


My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.


Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.


help and save mi. I dey sing for joy, bikos I dey under yor shadow.


E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us.


Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!


Dem kon tell Assyria sojas sey, Egypt sojas wey King Tirhakah for Sudan dey lead, dey kom attack dem. As di king hear dis tin, e kon send leta go give King Hezekaya


God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”


“For dat same day afta I don distroy Egypt finish, I go send messenjas for ship go tell Ethiopia pipol sey wahala dey kom. Dem dey tink sey dem dey save, but naw, fear go katch dem.”


God sey, “Ethiopia pipol, I go kill all of una with my swod.”


My pipol wey skata before, go from di oda side for Ethiopia river kon sakrifice give mi.


“O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.


God go bless yu for evritin wey yu dey do! Di Oga wey bi Israel God wey dey protet yu, go pay yu for all di good tins wey yu don do!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ