war go kom meet una and all una strong house go skata. Dat day go bi like wen King Shalman fight and distroy Bet-Arbel town kon kill both mama and dia shidren.
I go distroy all di place where Isaak shidren-shidren for dey woship juju and skata all dia holy place for Israel. Jeroboam shidren-shidren nor go bi king again.”
Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”