Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 17:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 God sey, “For dat time, Israel pipol pawa go finish and na sofa go bi dia own.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 17:4
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e si seven melu wey dirty and tin dey kom for dia back from di river too and dem stand near di fat ones.


King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Bikos of dis, Oga God wey get pawa go ponish en pipol with sickness. Yes! En glory go-go up like smoke.


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


Dis na wetin go happen for evriwhere for di world. E go bi like wen dem dey plok olive tree fruit for harvest time kon leave only di small-small wons for der.


Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem dey praiz Israel pipol God wey dey raitious. But I nor get hope at-all and na die I dey die go so, bikos pipol wey dey lie, still dey lie and doz wey dey deceive odas, still dey deceive!


Manasseh pipol dey fight Efraim pipol, den dem join togeda go fight Judah pipol. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


God don sey, “I go judge Israel pipol wey bi Jakob shidren-shidren.”


“So naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go judge both di strong and di weak sheep.


Oga God sey, “Na only few pipol for Samaria go eskape with dia life and with small piece for dia bed and chair. E go bi like wen shepad save two leg and some part of en sheep ear from lion mout.”


God go make dem fear as E dey distroy all di gods for di land.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ