Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 17:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 True-true, di day una start to plant, una dey do evritin wey una fit do, so dat di plant go grow. Di morning wey una start to klean di land, una dey do evritin wey una fit do to make di plant survive, but una nor go si anytin harvest and na only diziz and pain go follow una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 17:11
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.


For morning, dem dey grow and shine, but for evening, dem go dry kon die.


E go bi like wen pesin gada rice kon blow di kanda trowey. Just like wen pesin dey blow kanda komot from rice for Refah Valley.


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


Wen una plant breeze, una go harvest heavy rain. Una korn nor go produce bread. Even if e produce, na strenjas go chop am.


Efraim pipol go bi like plant wey en rut don dry and nor dey bear fruit again. Dem nor go get shidren and even if dem get, I go kill di ones wey dem like pass.”


Di seed dem die for dry groun. No korn to keep, so awa store don empty and skata.


All una hard work nor go do una good, bikos una land nor go produce food and di trees nor go bear fruit.


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


Una go plant and kare for una vineyard, but una nor go drink di wine or chop di grapes, bikos worm go distroy evritin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ