Make una pray kon sey, ‘Awa Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us kon save us from dis nashons! Den wi go tank and praiz yor name wey dey holy.’
And before dem go gada di grapes wey don ripe afta di new leaf don fall, I go use my knife take kut di branches wey nor dey produce fruit kon break all di bad branches.
bikos na Yu dey protet poor pipol and doz wey nor get anytin. Yu dey protet dem from rain kon kover dem from hot sun, bikos di way wiked pipol dey bihave, bi like heavy rain wey dey fall.
But una go sing just as una dey do wen una dey do festival for evening; una go happy like pesin wey dey blow trumpet go woship for di Oga God mountin; di God wey dey protet Israel.
So my pipol, make una nor fear or shake! Una know sey from biginnin kon rish naw, I always dey tok di tins wey go happen and una bi my witness. E get any oda god apart from mi? E nor get any oda god, wey get pawa. I neva si or hear about any one?
Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
sey, God dey announce give di whole world naw sey: “Make una tell Jerusalem pipol sey God dey kom save dem and E dey kom with doz wey E don already save.”
My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”
Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”
“I dey hear one nois on-top di hill: Na Israel pipol dey kry and beg dia juju. True-true, dem dey stay inside sin and don forget di Oga wey bi dia God.
Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.” Dis na wetin God wey get pawa tok.
My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
Israel pipol build royal palis, but dem don forget who kreate dem. Judah pipol don build many strong town, but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”
I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.
So, pipol go tif and karry dia propaty kon skata dia house. Dem go build new house, but dem nor go ever stay inside. Dem go plant vineyard, but dem nor go ever drink from di wine.
Di woman wey una dey won marry, anoda man go rape am. Una go build house, but una nor go fit stay inside. Una go plant vineyard, but una nor go chop dia fruit.
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.