Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 17:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Dis message na about Damaskus pipol, “Si, Damaskus town go disappear and e go turn where dem dey trow dirty put.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 17:1
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So for nite, Abram divide en men against di four kings men kon win dem. E porshu dem go rish Hobah wey dey nort for Damaskus.


But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, wetin Yu go give mi, since I neva born pikin and na dis Elieza for Damaskus go inherit my propaty?”


kon bi leader to some pipol wey nor dey respet di law. (Dis tin happen afta David don win King Hadadeza kon kill all di sojas for Siria.) Rezon and en men go stay for Damaskus where en men for make am Siria king.


Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.


Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help King Hadadeza, David attack and kill 22,000 sojas.


E sakrifice give Damaskus juju, bikos e tink sey na di juju win am. E tok for en mind sey, “Bikos Damaskus juju help en pipol, I go sakrifice gi-am, so dat e go kom help mi too.” But dis won kon make Assyria sojas distroy en and evribody for Judah.


Di Oga wey bi en God kon gi-am to Siria king. Siria pipol win and karry Judah pipol go Damaskus as prisonas. God still gi-am to Israel king and e kon distroy en kingdom.


I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.


Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.


Dis message na about Moab. True-true na one day God go take distroy am; dem go distroy Ar and Kir wey dey Moab for one singol day.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


Yu don turn di towns to where dem dey trow dirty put. Di place where strenjas for dey save before, nor bi town again and nobody go ribuild am.


So, yu neva hear sey na so I plan all dis tins since? And naw, I don do am; bikos na mi give yu pawa to take skata all di towns wey dem protet.


Even before di pikin go know how to rijet evil and choose wetin dey good, doz two kings wey dey make una fear, God go don skata dem with dia pipol.


bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.


Before di pikin go big rish to sey, ‘Papa or Mama,’ all Damaskus propaty and di tins wey dem karry from Samaria, Assyria king go kom karry dem go.”


But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois, den dem go distroy and burn dia village rish groun. Den Israel pipol go take dia land back from doz wey take am from dem.


“So mi wey bi God go turn Samaria to where pipol go dey trowey dirty put and dem go dey plant vine for der too. I go skata en stones for di valley kon espose en foundashon.


So, bikos of una, I go klear Zion like field; Jerusalem go bi where dem dey trowey dirty put and di temple go turn hill wey grass grow kover.


Na Oga God give mi dis message against Hadrak and Damaskus town. Evribody dey look up to God make E bless dem, especially Israel pipol.


kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem.


Una must gada all di dirty for der kon put am for di street centre, den burn di town rish groun as ofrin to di Oga una God. Una must distroy di town forever and make nobody build am again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ