Dem distroy di town and each of dem kover all di good land wey dey der, with stones. Dem stop di place where wota for dey flow kon kut all di betta trees for der. Dem distroy evriwhere escept Kir-Heres wey bi di main town. Den di men wey karry katapault kon attack and distroy am.
Even dia neighbours; doz for nort wey dey far like: Issakar, Zebulun and Naftali tribe, still bring donkey, kamel and melu kon load dem with food, flour, fig, raisin, wine and olive oil. Dem still bring sheep, so dat di men go chop and Israel pipol kon dey happy more-more.
But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”