Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 16:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up. Wi know sey di pipol sturbon well-well, but na empty mout dem just dey make.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 16:6
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.


Dis message na about Moab. True-true na one day God go take distroy am; dem go distroy Ar and Kir wey dey Moab for one singol day.


Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.


God go protet and guide Mount Zion, just as pipol dey mash grass pass, na so too E go take distroy Moab pipol.


Even wen dem stresh dia hand like man wey won swim, God go ponish dem and dia hands go weak, bikos of dia pride.


Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.


Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.


Na mi dey fool pipol wey dey si vishon kon make dia work taya dem. I dey shange wise pipol advise to anoda tin kon turn dia wisdom to foolishness.


Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa or sey una strong well-well for war?


God sey, “Make Moab stagga kon fall like pesin wey don drink, bikos dem go against mi. Moab go roll on-top en vomit and pipol go laf am.


Moab go skata and nobody go know am again, bikos God don curse am.


Dem go distroy en profets wey dey lie and pipol go si dem as fools! En sojas go dey die and fear go turn dem to mumu.


Dis na wetin Oga God tok, “Moab pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem nor respet Edom kings wey don die since; instead dem burn dia bones to ashes.


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ