14 But naw, God sey, “For di next three years, Moab pipol and dia propaty go vanish komot dis eart and na few pipol go survive among all di pipol and dem go dey weak well-well.”
My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.
God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.