10 Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard; nobody dey dance or shaut; no grape even dey to press to make wine, bikos I don end dia shaut for joy.
Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.
Una wey dey di land, wahala dey kom meet una. Di time go soon rish wen una nor go dey do party for di juju house wey dey di mountin, but na so-so kry una go dey kry.
God sey, “Di day dey kom wen korn go kwik grow even before harvest time rish and grape go grow kon ripe before dem suppose make wine. Sweet wine go dey rush kom out from di mountins and wine go dey flow for di hills.
So, pipol go tif and karry dia propaty kon skata dia house. Dem go build new house, but dem nor go ever stay inside. Dem go plant vineyard, but dem nor go ever drink from di wine.