Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 15:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Heshbon and Elealeh pipol go kry and Jahaz pipol wey dey far go hear dem. Bikos of dis, Moab sojas dey shaut with pain and dem nor get heart again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 15:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Rebekah tell Isaak, “I nor dey happy bikos of dis Het dotas. E betta make I die, instead of Jakob to marry one among dis Het dotas wey dey dis land!”


as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.”


Why dem born misef? Na make I for si trobol and always dey kry, so dat my life go end with shame.


“Judgement don kom di towns wey dey up and dem bi: Holon, Jahza, Mefaat,


Heshbon and Elealeh pipol kry well-well and dem hear dia kry for Jahaz, Zoar, Horonaim and Shelishiyah town. But Nimrim river, don dry.


But I nor go kill dis wiked pipol finish, instead I go skata dem go difren place where dem go for dey beg make dem die. Mi, wey bi God, don tok.”


So my God, make Yu just kill mi. E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”


Wen sun start to shine, God kon send one hot breeze kom from east. Di sun dey shine for Jonah head and e nearly faint. So as Jonah dey vex, bikos di plant wey kover en head don die, e kon sey, “E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”


E betta sey make Yu kill mi, dan sey make Yu dey trit mi like dis. If really sey Yu dey good to mi, den make Yu allow dis trobol pass mi.”


But King Sihon nor gri make Israel pipol pass en aria; instead e gada all en sojas kon go attack Israel pipol for di wildaness. Wen e rish Jahaz, e kon fight against Israel pipol.


Bikos fire kom out from Heshbon, betta fire kom out from Sihon town. E don distroy Ar wey dey Moab and di ogas wey dey for Arnon.


Wen King Sihon and all en sojas gada kon fight us for Jahaz,


For dat time, pipol go look for deat, but dem nor go si am. Dem go won die, but deat go run from dem.


But King Sihon nor gri, instead, e gada all en sojas, go kamp for Jahza kon attack dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ