Yu send yor savant kom boast give mi sey yu don defeat di highest mountins for Lebanon with all yor shariot. Yu dey boast sey yu dey kut di cedars tree wey tall pass and di cypress tree wey fine pass for der. Yu still sey yu don rish di place wey far pass for di forest
Wen I send am go where dead body dey, nois wey e go make wen e fall, go shake di whole world. All di trees for Eden and di betta wota for Lebanon wey dey under di world, go happy wen e fall.
Cypress, make yu kry take body nak groun, bikos di cedar trees don die and doz fine-fine trees don dey yuzles! Bashan oak trees, make una kry take body nak groun, bikos dem don kut una for groun!