God sey, “I go bring wahala kom di eart and I go ponish all di wiked pipol, bikos of dia sin. I go make anybody wey dey proud, honbol and I go ponish evribody wey dey sturbon and wiked.
Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break, but make dat one nor make una dey happy. If one snake die, di one wey bad pass go take-ova, bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
Dem vex skata and kill pipol for oda kountries and dem nor dey taya. Dem vex rule oda kountries as dem like kon dey opress di pipol and e nor taya dem.
Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.
All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.
Even doh dem hear sey I dey sofa, nobody gri kom konfort mi. My enemies know sey I dey trobol and dem dey happy to si as God ponish mi. Make di Judgement Day wey Yu promise kom, so dat dem go sofa, just as I don sofa so.