Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey, “Dis na sign of wetin dey happen. For dis year and next year, na food wey grow on en own, una go chop, but di year wey go follow dat one, una go plant and chop una food. Na so too una go plant vine and chop di grape.
Di pipol go dey waka anyhow for di land, dem nor go get hope and dem go dey hongry. So bikos of di honga and vexnashon, dem go look up kon curse dia king and God.
Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry. Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful. Dem even dey chop dia own shidren join.