28 Na for di year wey King Ahaz die, God take send dis message:
King Ahaz kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Hezekaya kon take-ova as king.
E make high place for evriwhere make dem dey give juju sakrifice for Judah. E make en grand-grand papa God vex well-well.
Ahaz die and dem beri am for David Town, but dem nor beri am for where dem beri Israel kings put. En pikin Hezekaya kon take-ova as king.
Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.
For di year wen King Uzzaya die, I kon si vishon as God sidan for en throne wey get glory for heaven and en klot kover di temple.
God wey get pawa sey, “Filistia pipol don revensh and kill Judah pipol well-well, bikos dem hate Judah.
Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.