Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 14:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 True-true, God wey dey lead heaven sojas get plan and who go fit stop wetin E won do? En hand dey ready to ponish anybody. So who go fit stop am?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 14:27
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

kon pray: “My Oga wey bi awa grand-grand papa God, na Yu bi God wey dey for heaven and na Yu dey rule di whole world. Na Yu get all pawa and nobody fit stand against Yu.


If God arrest and put pesin for prison or karry am go kourt, na who won stop am?


E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?


“I know sey na Yu get pawa pass! Yu fit do anytin wey Yu won do and nobody fit stop!


Nobody fit stop am. E dey take wetin E won take. Nobody fit even ask am, ‘Wetin Yu dey do?’


But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Na God wey dey lead heaven sojas do am. E do am to stop dia pride and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.


Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”


I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen.


Even if una plan, una nor go susid. Make una tok anytin wey una wont, but all of dem go dey yuzles, bikos God dey with us.


Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”


But some of una go eskape from Egypt kon go back to Judah. Den, doz wey survive go know wish pesin word happen. Weda na my own or dia own.


So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol and wetin I won do to di pipol wey dey Teman town. Dem go drag dia shidren go and I go distroy di land finish bikos of di tins dem do.


Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah.


I go leave only one small rock, so dat doz wey dey katch fish go dey sun dia net for der. Dem nor go build di town again. Mi, wey bi God, don tok.”


And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ