Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 14:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 14:25
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God kon send angel go kill all di soja, prince and offisa for Assyria. So, King Sennakerib kon shame go back to en town. Den wen e go en god temple, en sons kon kill-am with swod.


But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem, I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”


God don break wiked pipol pawa and di hand wey dem take dey rule.


Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.


Jerusalem pipol, make una shake unasef kon dey free! Make una stand up from dirty kon sidan for una throne! Zion pipol, make una luz di shain wey tie una!


All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.


“Assyria pipol dey der with all en sojas grave. All of dem die for war


Gog, en sojas and all di pipol wey dey stay with am go die finish for Israel mountin and I go let bird and wiked animals chop dia body.


E go give us peace. Wen Assyria pipol kom attack and break enter awa town, wi go choose seven rulers wey go wosh ova us and eight priests wey go lead us.


Dem go rule Assyria with dia swod kon enter Nimrod land. E go save us from Assyria pipol wen dem kom attack us.


Naw, I go skata and distroy Assyria pipol and dem nor go worry my pipol again.”


Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ