Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 14:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 but yu nor get grave, just like bullet wey dem shot trowey. Yor dead body just dey groun with oda pipol wey dem kill with swod; with pipol wey dem won go trow dia dead body for pit.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 14:19
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”


“Anybody for yor relashon wey die for di town, na dog go chop am and any one wey die for di open field, na vulture go chop am.”


Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey,


Anybody wey dem katch, dem go shuk am die and anybody wey dem seize, na swod go kill-am.


And all di kings for di world liedan for dia grave,


Nobody go beri dem; dem go rotin for groun. Dem go dey smell for evriwhere and dia blood go kover di mountins.


God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.


Rish and poor pipol go die for dis land and nobody go beri or mourn for dem. Pipol nor go kut dia body or shave dia hair to show sey dem dey mourn for dem.


Just as dem nor dey beri donkey wey die, na so too dem nor go beri am. Dem go drag en body komot from di town kon trow am outside Jerusalem.”


But as dem just enter di town, Ishmael and en men kill dem kon trow dia body put for well.


Di well wey Ishmael trow di men dead body put, na King Asa dig am wen King Baasha for Israel kom attack am. Naw, Ishmael don pak dead body full am.


Dem go wound kon fall die for all di street wey dey dia towns.


and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.


Dem nor beri dem as dem bin dey beri pipol wey really fight and die for dia kountries; pipol wey dem beri with dia swod under dia head and dia shield for dia body. Dis pipol dey make pipol fear wen dem dey alive.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ