I go make Cyrus take akshon, I go make all en road strait. E go ribuild my town kon free my pipol wey dem karry go anoda land and nobody go pay or bribe am.” Dis na wetin God tok.
Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.
and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.
Yes, I go vex distroy dia land. I go make dia land empty and from sout, e go bi like desert go rish Diblah town for nort. Yes! E go bi like dat for evriwhere wey dem dey stay. Dat time, dem go know sey na mi bi God.’ ”
Dem go distroy evritin wey dem si like sey na fire burn dem. For dia front, di land bi like Eden Gardin, but wen dem don pass, e go bi like desert for dia back. Dem go distroy evritin finish.