Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 14:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Babilon king, yu wey bi di morning star wey dey shine; make yu si as yu fall from heaven, just as devil fall! Before-before, yu katch many pipol, but naw, dem don trow yu for groun.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 14:12
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true, all di stars and oda tins wey dey shine, go stop to shine. Di sun go dark as soon as e won kom out and di moon nor go give any lite again.


All di stars go vanish komot, di sky go disappear like book wey dem klose and di stars go fall like dry leaf wey fall from vine or fig tree.


Before, Babilon pipol skata di whole world. But naw, dat hammer wey dem use, don skata. Pipol shok as dem si wetin happen to di kountry.


Even if Babilon klimb go sky kon build strong house for der, I go still send pipol go distroy am. Mi, wey bi God, don tok.”


God disgrace Zion bikos E dey vex. E don trowey Israel pride from heaven kom down and E nor protet di temple again bikos E really dey vex with dem.


Dem go sing sorrowful song for una sey: “ ‘Di town wey evribody know, don skata! Na en ship bin full di sea before, en pipol bin dey rule di sea and dey make evribody fear.


But even if una fly like eagle or build una house among di stars, I go bring una kom down!” Na so mi, God, tok.


Jesus tell dem, “I si Satan wen e fall like tunda-lite from heaven.


Afta dat one, wi bilive wetin di profets prish. Una go do well if una hear and follow di lite wey dey shine for darkness and wen day break, di star wey dey kom for morning, go shine for una heart.


God nor sorry for di angels wey sin, E trow dem for hell and tie dem for darkness until di day wen E go judge di world.


E go get di same authority wey I get from my papa and I go still gi-am di star wey dey shine for morning.


“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”


Den di third angel blow en trumpet and one big star from di sky fall kom from heaven like tosh wey dey bring fire. Wen dem divide evritin for di river into three, e fall for one part.


Den di fift angel blow en trumpet and I si one star wey fall from heaven kom eart and dem gi-am di key wey e go use take open di pit.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ