Bikos both wise and foolish man, go die and time dey kom wen dem nor go remember di wise pesin just as dem nor go remember di foolish pesin again! So one day, pipol go forget di two of dem.
I go take am go where dead body dey. I go make una stay for dat undagroun wey empty and na dead body go bi una friend. Bikos of dis, una nor go ever kom out or stay with pipol wey dey alive again.
Pipol wey dey strong for dis life before dem die and doz wey fight for Egypt before, go welkom Egypt pipol wen dem kom where dead body dey. Dem go shaut: ‘Wiked pipol wey dem kill for war don kom relax for here!’