Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 13:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So bikos of dis, evry hand go weak and evribody heart go fail am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 13:7
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make dem vanish like wota wey dey flow! Make dem dry like grass wey pipol go burn trowey!


Den Edom leaders go fear well-well; di strong men for Moab go dey shake and di pawa wey Kanaan pipol get, go vanish.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


Doz wey dey stay der nor bin get pawa and fear dey katch dem. Dem bi like grass for field or grass wey dey grow on-top roof wey east wind go soon blow komot.


Una shidren dey fall and faint street, bikos dem don weak; dem bi like animal wey hunta net katch. Dem don si how God vexnashon dey bi.


Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok. Wen e hear sey dem dey kom, fear and pain go nearly kill-am like woman wey won born.


Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.


So man pikin, make yu kry well-well, bikos I sharp dis swod to take kill my pipol and all di leaders for Israel. Dem go kill evribody, so make yu nak yor lap, bikos of dia pain.


If dem ask yu sey wetin make yu dey kry, make yu tell dem sey, na bikos of di news wey dey kom. Wen di news kom, fear go katch dem well-well; dia hand nor go fit move, dia mind go fail dem and dia leg go dey shake. Di time don kom and na naw.” God wey get pawa don tok.


Evribody hand go dey weak and dia legs go dey shake.


Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.


Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!


So wetin don happen to Nineveh, dat great town? Dat place where lion full? Just as lion and en shidren nor dey fear to waka, na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.


Wen wi hear di news, fear katch us and wi kon dey tink sey wi go die wons wi si una. Bikos di Oga wey bi una God, na God for heaven, eart and evritin wey dey under di eart!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ