21 Na wild animals go dey stay der and na birds go full dia house wey go don skata. Ostrich go dey stay der and na for der wiked goats go for dey play.
I go turn Babilon to where birds and wild animals dey stay and wota wey nor dey go front or back, go full di land. I go swip am trowey, just as pesin dey use broom take swip dirty trowey.”
Make una si Kaldean town, pipol wey nor know where dem from kom! Assyria pipol don turn di land to where wild animals dey stay. Dem don skata dia towas, distroy dia strong town kon turn am to where dem dey trow dirty put.
Bikos dem don run leave dia strong town. Di town wey pipol bin full don turn empty place. Nobody dey stay dia hill and towas again and naw, na der wiked donkey and sheep dey for chop grass.
E nor go tey before wild animals go kom take Babilon land and di town go turn where birds dey stay. Pipol nor go ever stay der again and e go dey empty forever.
Grass and wild animals go full di town. Owls go dey play for der and dem go dey shaut thru di windows. Dirty go block all di road wey dem dey pass enter di town and all di fine-fine buildings, go fade finish.
E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.