So Mikah kon ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, so make dem go dia house with peace.’ ”
Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.
Make una kill all di farmer wey dey plant for di town. Make all di strenjas go back to dia own pipol. Make dem rush go back to dia land, so dat doz wey dey attack, nor go kill dem join Babilon pipol.”
Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”
Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.