Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 13:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 True-true, all di stars and oda tins wey dey shine, go stop to shine. Di sun go dark as soon as e won kom out and di moon nor go give any lite again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 13:10
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di One wey kommand di sun and di sun nor raiz; di stars sef nor shine for nite.


Remember am before di sun, moon and stars go dark and before kloud disappear wen rain don fall finish.


For dat time, God go ponish di wiked spirits wey dey di sky with doz wey dey rule as kings for dis world.


Di moon go dey dark and sun nor go shine again, bikos Oga God wey dey lead heaven sojas, go rule from Mount Zion for Jerusalem and evribody go si en glory wey big well-well.


“Babilon, sidan for darkness and make yu kwayet, bikos pipol nor go koll yu kween again!


Wen dat day rish, di sojas wey dey kom from far, go make loud nois give Israel pipol; di nois go sound like wave for sea wey nak rock. Den wen yu look di land, yu go si sey e skata and dey dark, bikos di kloud don turn dia lite to darkness.


I fit kover di sky with darkness kon make am wear sak like who dey mourn.”


Di eart and sky dey shake as dem dey kom. Di sun and di moon kon dark wons and stars nor shine again.


Di sun go turn to darkness and di moon go turn to blood. All dis tins go happen before di great day wey God don choose, go kom.


Di sun and moon don dark and di stars nor dey shine again.


Instead make God day bring lite, na darkness go follow am kom. Dat day nor go good at-all, bikos e go dark well-well.


But E go use heavy rain take distroy en enemies finish kon porshu dem enter darkness.


For dat day, lite nor go shine again; di place wey dey bring lite from heaven, go stop.


“Afta di wahala wey go happen for dat time, “Di sun go kon dark and di moon nor go shine; stars go fall from heaven and heaven go dey shake.


“But for dat time, afta di sofa, “di sun go dark and di moon nor go shine again.


“Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For inside dis world, pipol for difren kountries go dey worry and fear, bikos of di way rivers go dey move and wota go dey rush from sea enter land.


Di sun go black and di moon go red like blood, before di big day wen God tok about, go rish.


Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ