Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop.
Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.
bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.
Anywhere di wota flow go, animals and fish wey dey dat place, go still dey alive. Di wota go make di Dead Sea wota fresh and anywhere dis wota flow go, evritin for der, go get life.
God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.
Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”
Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.