Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 11:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 E go always dey happy to obey God. E nor go judge pipol anyhow or with wetin dem tell am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 11:3
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”


So di king ansa, “Make yu dey go yor house and I go take kare of dis matter.”


Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.


So, make Yu give mi wisdom to rule yor pipol with good mind and to know wetin dey good or bad. If not, how I go take rule dis yor many pipol?”


But as yor tongue dey taste food, na so too yor ear dey hear word.


Una know betta food wen una put am for mout, but una ear nor know wise word wen e hear am.


If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God and yu go susid as yu dey learn about God.


So, if yu listin to wetin I dey tok; yu go know wetin dey rite, true and korrect, den kon know wetin yu suppose do.


Na-im dey make en pipol strong kon make dem dey save. E dey protet and give dem wisdom and na only doz wey dey fear am, E dey do all dis tins for.


Dis aria go bi di prince wey dey rule Israel own, so e nor go opress di pipol again and di remainin part for Israel go bi di tribes own.”


God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.


Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.


E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.


Make una nor dey judge pesin, bikos of wetin una si with una eye, but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”


But solid food na for mature pipol and dem get betta sense to know wetin dey good and bad.


But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ