Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 11:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 E go kreate one way wey en pipol wey remain go take komot for Assyria land, just as e happen for Israel pipol wen dem dey komot from Egypt.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 11:16
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side.


If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.


But time dey kom wen Israel pipol wey go survive nor go depend on di pipol wey almost distroy dem. Instead dem go only depend and trust Israel God wey dey holy.


Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.


Wen dat time rish, betta road go dey between Assyria and Egypt. Pipol for di two kountry go dey travel go visit each oda and di two nashon go woship togeda.


Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.


I go turn all my mountins to betta road kon prepare road for di hills, so dat my pipol go fit travel pass.


Si, my pipol go kom from far; some from nort, west and from Egypt wey dey sout.”


Na Yu dry di sea kon make road for inside wota, so dat di pipol wey Yu won save, go fit waka pass for dry groun.


God sey, “Klear di road! Klear di road! Make una remove di tins wey fit stop my pipol to turn back kom meet mi!


Jerusalem pipol, make una go outside di town go build road for una pipol wey dey kom back! Make una do betta road kon remove all di stones for der! Make una put one sign, so dat all di nashons go know


Doz wey remain for Judah go stay for der. Dem go stay and dey chop for di house wey Ashkelon pipol run leave. Oga God go visit en pipol with kindness and make dem prosper again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ