Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 11:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 God go divide Egypt pipol sea; E go wave en hand pass Eufrates River kon send one strong breeze, den E go turn am to seven small river wey don dry kon make pipol dey waka pass with ordinary leg.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 11:15
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.


So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side.


But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side.


For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem.


God wey make road pass di sea and where wota dey, dis na wetin E tok.


Na mi kommand di sea make e dry and e dry own.


Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.


Doz wey Yu don save go rish Jerusalem with joy, dem go dey sing and shaut with happiness. Dem go dey happy and dey free from sorrow forever.


Where God wey do great tins thru Moses wey divide di sea kon lead en pipol pass di deep wota, so dat honor and glory wey nor dey end, go bi en own?”


Wen dat time rish, God go bring di pesin wey dey barber hair for Eufrates side, wey bi Assyria king and e go kut di hair wey dey una face, head and body komot.


mi wey bi God go bring kings and dia sojas kon attack Judah. Dem go kom like Eufrates River wey dey flow well-well.


I don turn both yu and di river enemy. I go make evriwhere for Egypt empty and nobody go dey der again. From Migdol town for nort go rish Aswan town for sout till e rish Sudan borda,


I go turn River Nile to dry land kon make wiked pipol rule Egypt. Yes! Strenjas go skata di whole town. Mi, wey bi God, don tok.”


Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.


Den di sixt angel pour wetin dey en basin put for River Eufrates. Di river dry and road kon dey for di kings wey dey kom from east.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ