Isaya 11:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English11 Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
and dem go know sey na mi ponish dem. “But I go send some of dem go far nashon wey neva hear how I dey great rish or si di great tins wey I dey do. Na with my pawa, I go take send dem go Spain, Libya and Lydia with dia strong men. I go send dem go Tubal and Greece and na dem go tell doz nashons how I great rish.