Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 10:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 10:9
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.


King Toi for Hamat hear sey David don defeat Hadadeza sojas.


Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.


Instead of Israel pipol, Assyria king kon pak strenjas from Babilon, Kutah, Avva, Hamat and Sefarvaim go stay for Samaria towns.


Where di gods wey dey Hamat and Arpad? Where di gods wey dey Sefarvaim, Hena and Ivvah? True-true, una tink sey any god fit save Samaria from my pawa?


Any of doz kountry gods don fit save dem from my pawa?


Afta King Josaya don do all dis tins for di temple, King Neko for Egypt kon go fight with Karkemish for Eufrates River and Josaya kon go try to stop am.


E even dey boast sey, ‘All my kommanders go bi king!


Dis message na about Damaskus pipol, “Si, Damaskus town go disappear and e go turn where dem dey trow dirty put.


Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


Di main road dey empty, bikos nobody dey travel again. Kontries dey break di agriment wey dem make with each oda and pipol nor dey respet one anoda again.


Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?


Yu don hear wetin Assyria king dey do any kountry wey e won distroy. Yu tink sey yu fit eskape from am?


Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”


bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.


Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.


Dis na wetin God tok about Damaskus: “Di pipol for Hamat and Arpad town dey worry and dem nor get rest, bikos dem hear bad news. Dia mind dey trobol dem like river and dem nor fit rest.


from Berotah and Sibraim (wey dey between Damaskus and Hamat kingdom) go rish Tikon town (wey dey di boundary for Hauran kingdom).


Dem dey ponish kings and use dia leaders make yeye. Dem dey laf all dia strong-strong towns. Dem dey kover towns with san-san kon seize dem.


and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ