Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 10:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 10:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di whole town dey make nois anyhow. Una pipol wey die, nor die for war, but na honga kill dem.


God go gada dem put for pit, lock dem for prison and afta dem don stay der tey, E go kon ponish dem.


Nobody go beri dem; dem go rotin for groun. Dem go dey smell for evriwhere and dia blood go kover di mountins.


God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.


Wiked and bad pipol wey dey di world, E go ponish dem with fire and swod kon kill dem well-well.


So God kon make dia enemies attack dem. E make dia enemy vex attack dem.


Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


Di leaders don konfuse dis pipol kon lead dem enter distroshon.


So God nor go let any of di yong men eskape; pity for doz wey dia husband don die or doz wey nor get papa and mama again. Bikos all of dem dey wiked; dem nor know God and evritin wey dem dey tok, bad well-well. But God vexnashon nor go end and E still dey ready to ponish en pipol.


Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry. Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful. Dem even dey chop dia own shidren join.


Manasseh pipol dey fight Efraim pipol, den dem join togeda go fight Judah pipol. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


If dem ask yu, ‘Where wi won go?’ Tell dem sey, ‘God sey: “ ‘ “Pipol wey dem don sey, na diziz go kill, na diziz go really kill dem. Doz wey dem sey go die for war, go really die for war. Doz wey dem sey na honga go kill, na honga go kill dem and doz wey dem sey dem go katch go as slave, dem go katch dem go.” ’


Even if una kill Babilon sojas well-well and na only di men wey una wound remain, dem go still kom burn dis town rish groun.”


So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.


Even if dem born, I go kill di pikin. Bad-bad tins go happen to dis pipol wen I don leave dem.”


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ