Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 10:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 God go kut dem with axe, just as dem dey kut big trees for forest and dem go fall for groun like Lebanon fine tree!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 10:34
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So angels, make una praiz God: Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand.


Just as pesin wey dey sick dey die dey go, na so too God go distroy Assyria forest and en beauti


E go distroy all di tall cedar trees for Lebanon, with di oak trees for Bashan


“Dem go kill Assyria pipol with swod for war and nor bi swod wey human being make. Assyria pipol go run from di swod and dem go turn dia yong men to slaves.


Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.


Yu send yor savant kom boast give mi sey yu don defeat di highest mountins for Lebanon with all yor shariot. Yu dey boast sey yu dey kut di cedars tree wey tall pass and di cypress tree wey fine pass for der. Yu still sey yu don rish di place wey far pass for di forest


So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!


I go send men kon distroy am. Dem go use dia axe take kut en fine cedar pilas kon trow dem for fire.


Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.


Una bi like cedar tree for Lebanon wey get betta shape, fine-fine branches and wey tall rish di kloud.


For di dream, yu si angel kom out from heaven kon sey, ‘Make una kut and distroy di tree, but make una leave di body for groun. Make una kover am with iron and bronze. Make una leave am for der with di grass, so dat dew wey dey fall from di sky go wet am, den make e stay with animals for bush.’ ”


So Israel pipol, dis na wetin God tok: “Even doh Assyria sojas get pawa and dem many well-well, I go distroy and skata dem finish for dis world. My pipol! I know sey I don ponish una before, but I nor go ponish una again.


And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels.


even angels wey get pawa pass dem, nor dey tok about dis tins for God present.


Den I si anoda angel wey get pawa dey kom down from heaven inside kloud and rainbow dey on-top en head. En face dey shine like sun and en leg bi like big fire.


Den one angel wey get pawa, pick one big stone, trow am inside sea kon sey: “Na so dem go take trowey Babilon di big town with force enter sea!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ