Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 10:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 den dem cross kon go sleep for Gibeah dat nite! Pipol for Rama town dey fear and di pipol wey dey for Saul village for Gibeah, don run komot der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 10:29
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem rite evry oda big tin wey King Asa do, plus di towns wey e fence, for Judah kings history book. But wen e don old, e kon get diziz for en leg.


God sey, “Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit konfort am.”


Oga God sey, “Israel pipol, na since una dey Gibeah una dey sin kom rish naw and una nor dey progress at-all. Una nor si as dem kill Gibeah wiked pipol for war?


“Make una blow di war trumpet for Gibeah! Make una blow di wiso for Rama! Make una blow di trumpet for Bet-Aven! Benjamin pipol make una shake with fear!


Just as dem sin for Gibeah, na so too dia sin and wikedness dey bad rish. God go remember dia sin kon ponish dem.”


From Benjamin tribe, dem give dem Gibeon, Gibeah,


Even Saul sef go en house for Gibeah. But some strong men wey God don tosh dia heart, follow am go en house for Gibeah.


Wen di pesin wey dem send rish Gibeah (where Saul dey stay) kon tell dem wetin dey happen, all di pipol kon bigin kry.


So Saul, en pikin Jonatan and di sojas wey dey with am kon kamp for Gibeah for Benjamin, while Filistia pipol kamp for Mikmash.


Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.


Filistia pipol kon send some sojas make dem go block Mikmash road.


Saul sidan for outside for Gibeah under one tree wey en fruit bi like gold for Migron. Di sojas wey dey with am na about six hundred.


For Mikmash road wey Jonatan must pass before e rish Filistia sojas kamp, two big rock dey der for each side: dem dey koll one Bozez and di oda one na Seneh.


Di rock wey face nort dey near Mikmash and di oda one wey dey sout dey near Gibeah.


Samuel kon go Rama, while Saul go en house for Gibeah.


Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ