26 Mi, God wey get pawa, go use my kane take flog dem, just as I flog Midian pipol for Oreb Rock. I go ponish Assyria pipol, just as I take ponish Egypt pipol before.
Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.
All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.
Di nashons dey vex, but di time wey yu go ponish dem, don rish. And na naw yu go judge doz wey don die kon reward yor savants; di profets; doz wey dey good and evribody wey dey fear yor name, both small and big. Dis na di time to distroy doz wey dey kause wahala for di eart.”
One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.
Dem katch two Midian shief wey bi, Oreb and Zeeb. Dem kill Oreb for Oreb rock and Zeeb for where dem for dey press wine and di place name na Zeeb. Israel pipol still porshu Midian pipol, but dem bring Oreb and Zeeb head kom give Gideon for Jordan River east.