25 E remain small for mi to ponish una finish, den I go distroy dem for una.
For dat nite, God send en angel go kill 185,000 sojas for Assyria kamp. Wen day break, all of dem don die.
Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem, una nor go si dem again.
Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.
God sey, “I dey use Assyria pipol as weapon to take ponish pipol wey I dey vex for.
So make una kry with pain, bikos di day wen God go judge una don near; di day wen God wey get pawa won take distroy evritin.
My pipol! Make una dey go! Make una enter una house kon lock una door! Make una hide unasef until God don vex finish,
“Even doh I leave una for shot time, I go take una back and show una my love wey nor dey end.
“Den di king go do wetin e like. E go dey make mout and karry body up sey, ‘I get pawa pass any oda god. I even high pass God wey dey heaven.’ E go dey susid until di time wey God won ponish am, don rish. God go do wetin E don plan.
Dis na wetin Oga God for heaven dey tok: E nor go tey again before I go shake di heavens and di eart, di sea and di dry land.
Bikos God word sey: “E nor go tey again before di Pesin wey dey plan to kom, go kom.