Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 10:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Some of dem go kom back! Yes Jakob shidren wey remain go kom back to dia God wey get pawa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 10:21
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Anywhere wey Israel pipol still remain, make dia neighbours help dem. Make dem give dem silva, gold, animals and ofrin wey dem go offa for God Temple for Jerusalem.


Even doh God go ponish Egypt pipol, E go still heal dem again. Dem go turn to am and E go hear dia prayer kon heal dem.


Doz wey go survive for Judah, go grow like plant wey en rut deep well-well kon produce betta fruit.


So Jakob shidren-shidren, make una listin; una wey remain for Israel, pipol wey I dey kare for, since dem born una.


Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.


God dey tell en pipol sey, “I go kom Jerusalem kon defend and save all of una wey turn from una sin kom meet mi.


So God tell Isaya, “Make yu take Shear-Jashub yor pikin go meet King Ahaz. Yu go si am for di side where wota for dey kom di pool, where pipol for dey wosh klot.


Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.


Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”


Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life. Mi, wey bi God, don tok.”


Israel pipol, make una turn back kom meet di Oga una God, bikos una sin don make una fall.


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.


Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”


but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ